Facebook

Saturday, July 16, 2011

Nigerians Planking!



Yes o! The Planking  buzz on net, twitter and different social network is still on and as e be say Naija no dey ever carry last, na im my people also join and before you fit say Obasanjo big belle!
different pictures of Nigerians planking started flooding the net. Just like you reading, na so me self open my mouth trying to find out wetin the thing mean? The reason behind it, or if people self dey enjoy am. But what i found out is nothing to write home about, though there are different theories as per the origin of this planking. But the important thing be say as long as the rest of the world dey do am, we self must join do am make e no come be say dem add am join Olympic games in the future or them dey use the thing win money and as we all know Naija no fit carry last! For those una Planking, I say make una carry go! But abeg make una no go plank for third main land bridge o! Or else na inside fish belle una go continue the planking.

No comments:

Post a Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...